Make you say na mi talk am, can Najia achieve industrialisation with 4,000mgw?

Is industrialization achievable with 4,000mgw?

Make you no say na mi talk aam oooo!

Di countri wey tru tru wan develop no go face electric lite?

Make you no say na mi talk say Naija govment sold off the national power station, dis no longer bi tori to any bodi.

But di tori be say seven years wey govment sold of di compani, di new owna neva add single improvment to di compani.

Di Genera Sekiteri, Comrade Joe Ajaero wey tell reportas this talk say di thing de worri his mind so tay him wonda how govment go sell big compani like this for akara moni to pipo wey no get interest of di countri and di pipo for heart.
Him talkam say, “na 4,000 megawat wey it dey when dey buyam naim it still dey till today.

“Wetin di investors dey do with di moni wey FG dey pour into di Discos, dey neva build fresh power generation plant or do strong improvment to wetin dey met on di groud since then till now. Wetin we dey see na so so increase in tariff for nothing, na only profit naim dem dey pursue, dem dey carry moni to banks but dey no give value to consumas, na so Nija go dey industrialisation?”

Di look wey allcitynews.ng do show say where odar countri like China dey pump 5,682,000,000MW, USA. 4,324,000,000MW, India. 1,368,000,000MW, Japan. 995,000,000MW, UK 338,000,000MW, Najia dey pump only 4,000MW for di whole countri.